Dem tori say 93 years old widow Dr Ruth Gothesman wey be former professor for Bronx school of medicine don come donate $1billion give d medical school, wetin dis come mean be say d school now go come be free for d medical student after dis borku donation. Dem tori am say dis na d largest donor wey any school for America don ever receive. We say make God bless her as she understand say na empty hand nai we carry come dis world and na empty hand nai we…
Day: February 27, 2024
Almost 20 student don kpai becos of meningitis for Yobe state
Daily Trust don dey tori say around 20 students don kpai for some boarding house school wey dey Potiskum, Fika, and Fune local government areas for Yobe State. Dem tori am say d kpai kpai so dey happen for government science technical college, government girls science technical college, and federal government girls college, and all of dem dey inside Potiskum. Dem come tori say other students wey d disease affect don dey respond to treatment for inside specialist hospital wey dey Potiskum. According to d tori wey dem tori say…
Court don jail two illegal bdc operate for kano state…
Tori don talk am say court for kano state don tell two men wey their name be Munkaila Sani and Mohammed Sani wey dey operate illegal bdc without license to go sidon for inside prison for one year. According to d informate wey EFCC informate for their long hand wey be former twitter, EFCC say d men come agree say dem guilty as charge after d man wey dey hit dat wood for table wey we dey call Judge tell dem say dem don break d law according to section 57 (5)…
Oronsaye report go come implement…
Federal government don tori we d people say d oronsaye report and recommendation wey him Mr. Oronsaye and e team bring come out since 2012 go come implement. President Tinubu don direct say make dem shine eye into d report and make sure say evry tin wey Oronsaye and e team talk for d report dem put am to action to make am shake body well well so that d plenty money wey dem dey waste for government go comot. We d people come hear with corner ear say according…
Make we d people nor dey pour petrol for wrong system…
According to pastor Femi Lazarus, e tori am for one of e message say wrong system dey always get power because say na d people dey poor petrol put. In oda words d man of God dey tori us say if you no want your local government chairman or chairwoman to thief make you your self able citizin nor thief. If dem appoint any of your relation as government official make you d citizin nor see am say na avenue to get rich, government work na to come serve d…
Youth Unemployment Benefits….
We D People, federal government don tori say e go stretch the catapult of social security payment to youth wey no get work for d country, nah after d execute meeting wey take place on monday nai d coordinating minister for we nation Wale Edun tori we d people, him come tori say dem go set up consumer credit scheme wey go help to cool down d wahala of d adjustment wey we d people dey face right now. Minister Wale Edun come still tori say when we d people…