As e come bi now, we nor need anybody to come from space to tell us say we need to shine our eye put for education mata for our children, especially for di almost 20 million wey nor dey go school wey di borku number dey north side. While na every citizen right to demand wetin dem want from dia gworment, and com decide to enter street to go tok as e dey do dem for bodi, we don see wetin fit happen wen children nor dey go school or…
Day: August 8, 2024
Everytin nor go always stay di same
For dis life, e go always good to remind ourselves say everytin nor dey always stay di same or e nor go always bi di same. Sometimes you go laugh, sometimes you go cry, but while e somehow bi like say we nor dey fit control di tins wey dey make us laugh or cry sometimes, nature don come empower us to always fit control or manage di situation. while we get dis for mind, we go kontiniu to pray say na so so wetin go make us laugh nai…
Innoson motors chairman don tori say CNG buses go soon brekete borku for everywhere for we kontri
Innocent Chukwuma wey be di founder and chairman of Innoson motors don tori say CNG buses go soon borku for we kontri, and dis go com help reduce price of transportation wey dey also contribute to serious hardship wey di pipo dey complain put since. Innocent tori dis one after he meet with presido Tinubu for Abuja on Thursday. Him tori say di CNG idea wey presido get na very good tin for di masses since Nigeria get plenty borku gas wey go power dis idea. Chukwuma com beg Nigerians…
Nigeria immigration don suspend one staff wey dey beg people money for airport
Di comptroller general of di Nigerian immigration service don tori say dem don suspend one of dia officer wey social media dey share upandan say him dey beg traveler money for one of di airports. Di comptroller Mrs. Kemi Nandap tori dis one on Thursday through Mr. Kenneth Udo wey be di immigration public relations officer. Di tori kontiniu say Mrs. Kemi don condemn dat bad habit wey di officer wey dem dey call Okpravero Ufuoma display before di traveller, she com tok say dat kind behavior nor show di…
Obasanjo don tori say AI fit help out of school children for Nigeria
Former presido Olusegun Obasanjo don tori say artificial intelligence (AI) fit become beta ogbonge tools wey go help shine light on top di many out of school children wey don almost turn to crisis for Nigeria. Na for di 50th anniversary of learning opportunities wey distance learning institute Unilag organize nai former presido for tori dis one. Obasanjo further tori say Nigeria get almost 20 million children out of school right now and artificial intelligence and open distant learning na some ways wey institutions fit take manage di situation.