Innoson motors chairman don tori say CNG buses go soon brekete borku for everywhere for we kontri

courtesy Innoson vehicle manufacturing.

Innocent Chukwuma wey be di founder and chairman of Innoson motors don tori say CNG buses go soon borku for we kontri, and dis go com help reduce price of transportation wey dey also contribute to serious hardship wey di pipo dey complain put since.

Innocent tori dis one after he meet with presido Tinubu for Abuja on Thursday. Him tori say di CNG idea wey presido get na very good tin for di masses since Nigeria get plenty borku gas wey go power dis idea.

Chukwuma com beg Nigerians to give presido Tinubu more time, him com further tori say innoson motors go soon carry CNG buses come out to support presdo idea, especially when di benefit of di CNG buses plenty well well, say na di benefit of dis CNG buses nai him see wey make him start di factory and him don already even start before presido bring di idea of di CNG buses come, and very soon everybodi go see am say dis presido idea na di way forward for we nation.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment