Everytin nor go always stay di same

For dis life, e go always good to remind ourselves say everytin nor dey always stay di same or e nor go always bi di same.

Sometimes you go laugh, sometimes you go cry, but while e somehow bi like say we nor dey fit control di tins wey dey make us laugh or cry sometimes, nature don come empower us to always fit control or manage di situation.

while we get dis for mind, we go kontiniu to pray say na so so wetin go make us laugh nai we go dey see, but if we get am for mind say tins nor dey always stay di same, den nothing go shock us no mata di outcome.

As you dey start your day my wish for you today bi say you go kontiniu to laugh.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment