Tori don talk am say court for kano state don tell two men wey their name be Munkaila Sani and Mohammed Sani wey dey operate illegal bdc without license to go sidon for inside prison for one year.
According to d informate wey EFCC informate for their long hand wey be former twitter, EFCC say d men come agree say dem guilty as charge after d man wey dey hit dat wood for table wey we dey call Judge tell dem say dem don break d law according to section 57 (5) of the Banks and other financial institutions Act, 2020 and punishable under Section 57 (5) (B) of the same act.
E dey against d law of our land for anybody to operate without d proper license, so u be illegal if you come decide to go dey operate, remember say d eyes of our Economic and Financial Crime Commission wey be EFCC dey everywhere and dem ready catch you and make you go spend better quality time for inside prison wey we dey call correction center, so that you go come correct well well when you come out.
Crime nor good, so make all of us join hands together to make our country better.. If you see something say something.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.