Make una see humanity of $1billion donation

Dem tori say 93 years old widow Dr Ruth Gothesman wey be former professor for Bronx school of medicine don come donate $1billion give d medical school, wetin dis come mean be say d school now go come be free for d medical student after dis borku donation.

Dem tori am say dis na d largest donor wey any school for America don ever receive.

We say make God bless her as she understand say na empty hand nai we carry come dis world and na empty hand nai we go still carry comot for dis world.

We also remember say sometime ago Femi Otedola give all d student of Augustine university 1 million naira each wey come amount to N750 million.

Make all d billionaire remember say na empty hand nai we carry come di world o, make dem continiu to dey donate to wetin go change people life especially in the area of education, as education is very importanta to d growth of any nation wey dey dis earth, especially for dis our Africa continent so and for our country Nigeria in particular.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment