Federal government don tori we d people say d oronsaye report and recommendation wey him Mr. Oronsaye and e team bring come out since 2012 go come implement.
President Tinubu don direct say make dem shine eye into d report and make sure say evry tin wey Oronsaye and e team talk for d report dem put am to action to make am shake body well well so that d plenty money wey dem dey waste for government go comot.
We d people come hear with corner ear say according to public opinion, one of d recommendations wey dey very important to dem na to see say d money wey government dey spend for pilgrim must now come to end.
Public tori come dey talk say if you wan go Jerusalem or you wan go stone devil, e go be your cup of tea, say those plenty borku money wey dem dey give people wey dey wan go pilgrim through that ministry go reach take build better road, better school and better health centers for many villages for we country.
We d people go dey wait to see how d cost of governance go take reduce and if this government go actually implement this report on top say since that time wey dem write d report plenty borku ministry don join the numbers wey dey inside d report. We wan believe say d government and e team know wat to do.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.