Youth Unemployment Benefits….

We D People, federal government don tori say e go stretch the catapult of social security payment to youth wey no get work for d country, nah after d execute meeting wey take place on monday nai d coordinating minister for we nation Wale Edun tori we d people, him come tori say dem go set up consumer credit scheme wey go help to cool down d wahala of d adjustment wey we d people dey face right now.

Minister Wale Edun come still tori say when we d people fit benefit from the consumer credit scheme, say goods go come borku brekete, d economy go come quick quick recover and we d people go come get better power to purchase and buy goods and product.

We pray say this nor go just be talk talk, say e go be say in the coming days our able youth wey never get work go still fit they get small small money for pocket to survive because of this benefits wey dem don promise youth so.

We also they ask our government to continue to provide better environment and policies wey go create borku work, because we d youth go prefer make we dey catch the fish by our self, nor be say we nor go appreciate the unemployment benefit o, we just say we like to work, we nor lazy, but we thank the government for this new one wey dem talk so and we d youth go dey wait to see.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment