Tori say na only less dan 40% of people for Africa dey use internet

According to International Telecommunication Union wey be United Nations specialized agency and official source for global ICT statistics don tori say even doe access to internet connection dey increase round d whole world na only 37% of d population for Africa dey use internet. Tori say while about 90% of d population in Europe, d Commonwealth of Independent States and North and South Americas dey use internet, Africa as a continent come get d lowest internet access for d whole world with only 37%. D tori come still talk say…

Philip Shuaibu don land PDP headquarters to demand certificate of return

Philip Shuaibu wey be deputy governor for Edo state don land for d headquarters of PDP to ask for certificate of return, because according to him, e say na him win d last primary governorship election wey PDP hold on February 22 2024. According to d governorship primary tori wey happen for Samuel Ogbemudia stadium for Benin, d chief returning officer come declare say nah Asue Ighodalo nai be d winner of d primary election after e win with 577 votes, base on dat win Asue Ighodalo come go collect…

Dem don detain some Binance executive because of crypto mata

Tori don talk say dem don detain two binance oga kpatakpata today because of d crypto wahala. Tori come say d two oga kpatakpata fly come Nigeria as dem here say Nigeria wan ban crypto currency. According to d tori, dem say officials never provide borku informate on why dem detain dem, say dem also block other platforms wey be forextime, octafx, crypto, fxtm coinbase, Kraken and others. The tori come continue say CBN governor Yemi Cardoso don dey worry say e be like say some kind kurukere market dey…

President don assure Nigerians say light must shine in the end

President Tinubu don assure Nigerians say no matter wetin dey happen now for we country say light must shine at the end. President come tori dis assurance when he tanda for d expatriate employment levy mata today, he come tori say with d kind people wey him put e place to manage d affairs of d economy say light must shine. We go only say make we d people continiu to pray for the president and e team because this light suppose shine.

Nigeria Labour congress NLC don suspend protest, come give ultimate

Nigeria Labour Congress wey be dey protest today don decide to cool small temper and suspend d nationwide protest for now, dem nor just suspend d protest, dem come give federal government ultimate wey dem say e go expire for March 13 2024 and dem want government to implementation d October 2 2023 agreement and other borku tori wey dey inside d letter wey dem present. According to d placard wey we d people see say some of d protesters carry nah say make government inside dis hardship support local…