Nigeria Labour Congress wey be dey protest today don decide to cool small temper and suspend d nationwide protest for now, dem nor just suspend d protest, dem come give federal government ultimate wey dem say e go expire for March 13 2024 and dem want government to implementation d October 2 2023 agreement and other borku tori wey dey inside d letter wey dem present.
According to d placard wey we d people see say some of d protesters carry nah say make government inside dis hardship support local industries, end naira devaluation, end poverty and hunger as dem nor see money withdraw take go buy food, fix d country refineries, dem say make government begin tax d rich people and give d poor people subsidy. Na dere nai senior advocate for Nigeria Femi Falana come tori say since wey dem remove subsidy all the tiers of government dey shine teeth enter bank but dem no care for deir people, say all dis our tiers of government suppose to manage deir own pot wey dey burn so dat deir people go fit breathe.
D hungry get as e be oo, so tey some of we d people come need to go kpai all becos say dem dey go line up tanda to collect rice.
We beg our government to quick implementation dis demand for d people at least even if na some wey go help d people to feed well.
We also use dis opportunity to call our money bag people for d nation say this na time to see your humanity o.
God bless Nigeria
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.