Tori say na only less dan 40% of people for Africa dey use internet

According to International Telecommunication Union wey be United Nations specialized agency and official source for global ICT statistics don tori say even doe access to internet connection dey increase round d whole world na only 37% of d population for Africa dey use internet.

Tori say while about 90% of d population in Europe, d Commonwealth of Independent States and North and South Americas dey use internet, Africa as a continent come get d lowest internet access for d whole world with only 37%.

D tori come still talk say na too much blackout because of say no light and no digital infrastructure for Africa nai dey cos am. 

Africa make una wake up, since na Africa nai d dream suppose dey base on everything wey God take bless d continent.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment