President Tinubu don direct Dangote, BUA, and oda companies to go back to d old price of cement

President Bola Tinubu don direct all d cement companies for Nigeria to go back to old price of cement as e be before. Na d Minister of Works, Senator David Umahi tori am on Thursday after him inspect BUA cement factory for Sokoto State. D minister come tori say d new presidential order dey ask all d cement manufacturing companies to go back to d previous price for cement to help the economic hardship wey we d people dey face dis time around.

House of representatives don tori say dem want make secondary school student dey do drug test cos of too much abuse

House of representatives don tori say dem want federal ministry of education to collaborate with federal ministry of health so dat dem go come out with by force drug test program for secondary school students in Nigeria because of d too many drug abuse these days. Dem come still ask d national orientation agency and d national drug law enforcement agency (NDLEA) to increase d tori on abuse among our secondary school students round d country. Dem also tori d committees on basic education and services, and healthcare services to…

Nigeria custom service don kpake fake medicine wey be pharmaceutical product.

Custom service for Nigeria don tori say dem don kpake fake fake medicine wey reach almost 1.4 billion naira for around oyo and osun area command. Na d oyo-osun area controller, Dr Ben Oramalugo nai tori dis on Wednesday as e dey talk to tori tori people wey english dey call reporters, oga area controller come tori say d fake medicine nah mostly d one wey dem dey call antibiotics wey dem pack inside sack. Oga kpatakpata Oramalugo come tori say anybody wey dey carry fake medicine na enemy of…

Association of table water producers don tori say Nigerians fit start to buy one sachet water for N100

D association of table waters producers don tori during deir press conference say right now even though one sachet water dey sell for N50 we d people fit start to buy one sachet for N100. Dem come tori say cost of production dey cripple deir business and put dem into more debt. Dem say almost all of dem wey be producers dey either get money from outside source or dey borrow heavily. D association members come tori say abeg make Nigerians bear with dem as d situation come be for…