Custom service for Nigeria don tori say dem don kpake fake fake medicine wey reach almost 1.4 billion naira for around oyo and osun area command.
Na d oyo-osun area controller, Dr Ben Oramalugo nai tori dis on Wednesday as e dey talk to tori tori people wey english dey call reporters, oga area controller come tori say d fake medicine nah mostly d one wey dem dey call antibiotics wey dem pack inside sack.
Oga kpatakpata Oramalugo come tori say anybody wey dey carry fake medicine na enemy of d country, him come also say nor be small amount dem catch. He further tori say plenty we d people for fall victim if to say dem nor catch d people wey bring d fake medicine enter we country.
Him tori say dem also catch oda things like 345 50kg bags of rice, 53 sacks of clothes wey dem don use, shoes and 1,309 pieces of tyres wey dem don also use, plus oda things wey him mention.
Oga tori say even doe d revenue wey dem don get for dis 2024 don reach N12.4 billion, d borders wey dey around dem still dey close and dem go continue to make sure say dem dey vigilant to prevent smuggling.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.