Our corner ear hear say Abia state go soon launch light rail construction project

Governor Alex Otti of Abia state don tori say im don dey discuss with some Chinese company on how dem go take bring light rail construction project wey go pass d whole state of Abia. E tori dis mata on Thursday for politics today as im dey trow more yannings give Seun Okinbaloye of channels Tv regarding d whole mata for geometric power wey dem just commission. Him come continiu to tori Seun say na one of e promises be dat and even if say e no go easy e…

Ballot development

Remember say every election, ballot box and ballot paper go reach all d villages for we country even doe say development nor dey reach dere. Make we nor stop to dey ask everybody wey we vote for to give we d people ballot development d way dem dey carry ballot box and paper come. Na our right as we d people to ask for accountability from d people wey we vote for. God bless Nigeria.

Health matas

Medical people say for good eyes make you eat carrot. And for good better shining skin make you eat or dey drink lemon water. For good kidney we d people continiu to drink plenty water For cough eat pineapple for stress eat banana Above all, take care of your mental health, nor too dey think, everything go dey alright. When dere is life dere is hope. if you fit pray, Pray.

Dem say one person don kpai and others dey hospital after dem chop cassava flour wey no good for ogbomosho

One person don kpeme and five others dey fight for their lives for ogbomosho oyo state afta dem chop cassava flour wey tori say e be like say dem cook am with cassava flour wey dem fit say na yam flour and d cassava flour no come good. Tory say d mata happun for Wednesday night, Feb. 28, for Temidire Atoyebi area along Ajaawa Road for Ogbomoso. Dem say d family wey dey involve na one grandmama wey dem identify as Mrs. Victoria Paul Adewole, and she get four children,…

Tori say lassa fever don kpai 9 people for IDP camp for Benue state

Lassa fever don kpai nine people for d past two months for Benue state. D state epidemiologist, Dr. Sam Ngishe, reveal dis one to journalists on Thursday, Feb. 29, im talk sey some of d people wey kpai dey live for inside d camp wey be for displaced people. Dr. Ngishe come tori say from deir report so far, d IDP camp get plenty rats, and if d rats wey dey transmit am dey for d IDP camps, e mean say dem go need to work well well so dat…

Vice President Shettima don tori say God reward Tinubu with presidency because say im heart pure

Vice President Kashim Shettima don tori say nah d pure heart wey president Tinubu get nai make God reward am to become Nigeria president. Shettima come tori dis one on friday, March 1 wen im host some we d people of d Nigerian Christian Pilgrim Commission (NCPC) wey come visit am for Presidential Villa, Abuja. ”Him come yan say d road wey carry im Tinubu reach presidency no be by chance, say apart from im pure heart Tinubu ready to sacrifice for d betterment of d nation. Oga VP come…

Tori don talk say inmate for jos area don dey protest because of say dem wan ration deir food due to hardship

D protest wey dey happun sake of d hunger wey dey rise for Nigeria, don enta another level on Friday as inmates kpokpo for d Nigerian Correctional Centre wey people know as prison for Jos, wey be di capital of plateau state don join d protest. D inmates start to protest as soon as dem hear sey dem wan ration d amount of food wey dem dey give dem. As d protest dey happun, d inmates no gree follow d orders wey d officers give dem and dem no come…

Labour leaders don reply Tinubu make him focus on d hardship for d country instead of 2027

Nigeria Labour Congress (NLC) don yab President Bola Tinubu because of im comment on top d protest wey d union do for Tuesday wey im call “unacceptable”. For one press statement wey NLC president, Joe Ajaero release on Friday, e tell d president make e use im energy solve d many wahala wey dey worry Nigerians, and make e no dey yarn grammar with labour people wey get d right to protest. Dem come still tory say make president focus on d promises im make to Nigerians. No forget say…

Kaduna residents come weleh BUA truck and carry plenty carton of their noodles wey be indomie run comot

Some pipo for Zaria for Kaduna State on Friday kon carry plenty cartoons of indomie comot from one truck wey dey move wey dey load foodstuffs wey belong to BUA company. One person wey be resident for di town tori am sey e happen for Dogarawa area of Zaria afta some youths dey para because say dem fit say d company dey among d manufacturers wey dey increase prices of dia goods without say dem no consider d no money for d average citizens. E tori say dem say dis…