One person don kpeme and five others dey fight for their lives for ogbomosho oyo state afta dem chop cassava flour wey tori say e be like say dem cook am with cassava flour wey dem fit say na yam flour and d cassava flour no come good.
Tory say d mata happun for Wednesday night, Feb. 28, for Temidire Atoyebi area along Ajaawa Road for Ogbomoso.
Dem say d family wey dey involve na one grandmama wey dem identify as Mrs. Victoria Paul Adewole, and she get four children, and one granddaughter. Dem say dem start to feel somehow after dem chop d food finish, nai dem start to cry before neighbors come rush come carry dem go private hospital for Ogbomoso Baptist high school area, where d granddaughter wey dey inside come kpai.
Dem say dem later carry dem go Ladoke Akintola University of Technology (LAUTECH) Teaching Hospital for Ogbomoso where medical people still dey try to save d others wey still dey alive.
Tori come further talk say one of d children manage talk say na cassava peel dem grind and turn am to flour since dem no fit buy yam or real cassava flour, say dem dey beg good people make dem help d family for any way dem fit so dat dem no go lose more lives among dem.
D chief medical director of Lautech teaching hospital, Professor Olawale Olakulehin come confirm d mata. E com also tori say four out of d five remaining family members dey respond to treatment for hospital.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.