Nigeria Labour Congress (NLC) don yab President Bola Tinubu because of im comment on top d protest wey d union do for Tuesday wey im call “unacceptable”.
For one press statement wey NLC president, Joe Ajaero release on Friday, e tell d president make e use im energy solve d many wahala wey dey worry Nigerians, and make e no dey yarn grammar with labour people wey get d right to protest.
Dem come still tory say make president focus on d promises im make to Nigerians.
No forget say Nigeria labour congress been protest days ago because of d hunger wey dem say dey we country.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.