Governor Alex Otti of Abia state don tori say im don dey discuss with some Chinese company on how dem go take bring light rail construction project wey go pass d whole state of Abia.
E tori dis mata on Thursday for politics today as im dey trow more yannings give Seun Okinbaloye of channels Tv regarding d whole mata for geometric power wey dem just commission.
Him come continiu to tori Seun say na one of e promises be dat and even if say e no go easy e must happen las las.
We congratulate Abia people on top dis ballot development wey Governor Alex Otti don honestly dey give e people.
Now we dey see am say to give good governance e nor dey hard.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
This governor na ogbonge governor, him dey try wella,abia people we dey jealous o