Tori don talk say inmate for jos area don dey protest because of say dem wan ration deir food due to hardship

D protest wey dey happun sake of d hunger wey dey rise for Nigeria, don enta another level on Friday as inmates kpokpo for d Nigerian Correctional Centre wey people know as prison for Jos, wey be di capital of plateau state don join d protest.

D inmates start to protest as soon as dem hear sey dem wan ration d amount of food wey dem dey give dem.

As d protest dey happun, d inmates no gree follow d orders wey d officers give dem and dem no come gree chop morning food. Dem just gather for d middle of d prison yard dey shout anyhow, but d officers come spray tear gas to chase dem go back to dia cells.

D Comptroller of Jos Correctional Center, Raphael Ibinuhi nai confam d protest wey d inmates do to Daily trust.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment