One hospital for our federal capital territory don dilapitate and d hospital need ballot box development

Usman Mohammed don share pictures of wetin dey happen for Kaida primary healthcare centre for gwagwalada area council for Abuja, im come share how d hospital take decay for e X handle, Usman say bush don cover d hospital and doors nor even dey plus windows nor good. Usman no come forget to mention Senator Ireti Kingibe, say d senator don neglect d hospital. We call on our able senator to look into dis mata and give d people d ballot box development.

Inspector general of police don ban POS operators for police station for d whole country

D inspector general of police, Kayode Egbetokun, don ban operators of point of sale wey we know as POS and other electronic mobile money transaction devices comot from police station and police facilities round d country. Oga IGP tori dis mata on monday say d ban dey necessary at dis time becos of d wayo transaction of POS machine operators with some police officers for we country. ACP Olumuyiwa Adejobi wey be d police public relation officer come further tori d mata say d directive from IGP na to preserve…

Ukraine don donate 25,000 tons of grains give north east Naija

D United nations world food program (WFP) don thank d government of Ukraine for their kind donation of 25,000 tons of wheat wey go help give emergency food support to almost 1.3 million people wey dey affected for northeast Nigeria. Na Atinuke Akande-Alegbe wey be senior communications and public diplomacy officer of d British high commission for Abuja nai tori dis mata on Thursday. Dem talk say dis important contribution na part of Ukraine’s humanitarian grain from Ukraine initiative wey President Volodymyr Zelenskyy launch. Dem add say d arrival of…

Reps don ask private airline operator to give account of d covid-19 relief funds

D house of representatives public accounts committee don give private airline operators for Naija one-week deadline to explain how dem take use d N4bn wey federal government give dem to fight COVID-19 or make dem refund d money if dem no fit provide evidence on how dem take spend am. D committee wey Bamidele Salam, one member of d Peoples Democratic Party from Osun State wey be d chairman nai give d ultimatum on friday for d resumed investigative hearing on top d mata wey concern mismanagement of COVID-19 relief…

Senate don talk say dem go probe d N30tn loans

Nigeria senate don talk am say dem go start to question some central bank officials on how dem take give out and d spending wey surround d 30 trillion naira loan for ways and means wey federal government collect during former president Buhari. Na d chairman of d senate ad-hoc committee senator Isah Jibrin nai tori dis mata for one of e tori, e come tori say d probe go start this week. D senate tori last week say dem go probe how dem take spend d money because d…

President Tinubu don tell Qatari official to report any Nigerian official wey go ask for kpaje wey dem dey call bribe

President Tinubu don tell ogas for Qatari industry to report any Nigerian official wey go ask them for bribe before dem do business for we country. Na d special adviser to d president on media and publicity, Ajuri Ngelale nai tori dis one for one of e tori. President Tinubu come still assure d international business community say Nigeria dey very serious and ready to do business and him go make sure say e administration remove any bottle neck wey go tanda for d road of any legitimate business for Nigeria.