D house of representatives public accounts committee don give private airline operators for Naija one-week deadline to explain how dem take use d N4bn wey federal government give dem to fight COVID-19 or make dem refund d money if dem no fit provide evidence on how dem take spend am.
D committee wey Bamidele Salam, one member of d Peoples Democratic Party from Osun State wey be d chairman nai give d ultimatum on friday for d resumed investigative hearing on top d mata wey concern mismanagement of COVID-19 relief funds by ministries, departments, and agencies of d federal government.
Tori say d committee dey investigate over 56 MDAs for d alleged mismanagement of d relief funds.
D committee come tori say, all d private airlines wey collect COVID-19 relief funds wey dem give dem to support d aviation sector must refund d money to d federal government purse if dem no fit show how dem take use d money and dem dey give d airline within one week to do so.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.