D United nations world food program (WFP) don thank d government of Ukraine for their kind donation of 25,000 tons of wheat wey go help give emergency food support to almost 1.3 million people wey dey affected for northeast Nigeria.
Na Atinuke Akande-Alegbe wey be senior communications and public diplomacy officer of d British high commission for Abuja nai tori dis mata on Thursday.
Dem talk say dis important contribution na part of Ukraine’s humanitarian grain from Ukraine initiative wey President Volodymyr Zelenskyy launch. Dem add say d arrival of dis wheat dey timely since prices of basic food for Nigeria don increase and e come make am hard for many families wey dey very poor for d country to chop well.
D tory continue say d shipment dey possible because of d collaboration between United Kingdom, Canada, Denmark, Finland, France, Luxembourg, Norway, Republic of Korea, and Sweden, because na dem help to cover d cost of transporting d wheat from Ukraine so dat dem go for share am give d families wey need am quick quick.
David Stevenson wey be world food representative country director for Nigeria come thank d government of Ukraine, partners, and donors for their better support through d grain from Ukraine Initiative since their effort dey help to reduce suffer for area wey dey face wahala and food prices
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.