D Peoples Democratic Party (PDP) don tori say dem legal team dey wait for Deputy Governor of Edo State, Philip Shuaibu for court over d mata of d party primary election wey happun for d state. Na d deputy national publicity secretary of PDP, Ibrahim Abdullahi, nai tori dis one, and add say d party no dey shake for d deputy governor threat to carry d mata go court to declare am as d authentic PDP candidate ahead of d state governorship election wey dey come for September. Abdullahi tori…
Day: March 5, 2024
EFCC don catch 21 trucks wey be wan thief our food go Cameroun and nearby countries
EFCC operatives for Maiduguri zonal command don catch 21 trucks wey full with food and other things. D anti-corruption agency tori say d trucks dey waka go N’djamena, Chad Republic, Central African Republic, and Cameroon. D agency tori say dem intercept d trucks for major road junctions for Kalabiri/Gamboru Ngala and Bama roads for Borno State. D agency tori say dem see food items wey dem hide inside d trucks, but dem catch am because their eye dey shine like eagle. Dem talk say dem check d papers wey cover…
Wike don set up FCT civil service commission
D minister for federal capital territory Nyesom Wike don announce on monday say im go set up civil service commission for capital territory. Na d meeting wey im hold with directors of FCTA and d Federal capital development authority FCDA nai im for tori dis one, im come still tori say d commission go appoint nine permanent secretaries to handle secretariats. Oga minster Wike come tori say d secretariats na transport and economic planning, agriculture and rural development, revenue generation and public private partnership, education, social development, legal services ,area…
Obi say e dey painful say na Ukraine come dey donate food give Nigeria.
D presidential candidate of Labour party for d 2023 general elections Peter Obi, don tori say, e dey very painful say na Ukraine wey dey fight war with Russia nai come dey donate food give Nigeria. Him tori say even though d food donations good, but e still go to show how d government of d day don fail to take care of e people. Peter Obi tori for am for im X handle say, d mata come dey be like national disgrace sake of say Nigeria wey God bless…
Marwa don advise parents to dey monitor their children very well
D chairman of Nation drug and law enforcement agency NDLEA rtd General Mohammed Marwa, don advise parents to dey shine their eye for their children body because of d so many drug abuse mata for d country. Him tori say make parents dey try to give better care to their children sake of say this fit help prevent d drug abuse wahala. D oga tori dis mata for d ramadan lecture wey d Alhaji Mohammed Lawal memorial jummat mosque, Asokoro, Abuja organize. E tori say d prevention efforts wey dem…
Buhari leave poor economy for Tinubu- Muftwang
D Governor of Plateau State, Caleb Mutfwang don tori say na Buhari administration nai cause d hardship wey Nigerians dey face right now. Him tori dis one on monday when im dey swear in 22 special advisers and heads of government agencies for government house Jos. D governor come talk say dem sell Nigeria future under d last administration wey dey under Buhari sotey dem print a whole 30 trillion naira and just share am. D governor come continue to tori say e owe d people d truth even though…
Idahosa say na him be authentic APC governorship candidate for Edo state
Dennis Idahosa of APC don write to d chairman of Independent national electoral commission INEC say make e no accept d name of any other candidate becus say na him win d governorship primary election wey dem hold on February 17th 2024. Nor forget say dem later declare d primary election inconclusive and come hold another supplementary election where d party for come declare Sen. Monday Okpebholo d winner of d APC primary election. Dennis tori for e letter say, na him win d February 17th 2024 primary election wey…
President Tinubu don return to Abuja from d Qatar waka
Vice president Kashim Shettima plus other government officials don welcome d president from e Qatar waka. Tinubu return on monday to Abuja after d two days visit to Qatar where im for sign some agreement on some sectors like education and others with Qatar.
Navy don arrest one ghana vessel wey thief two million litre of our oil
Navy under operation Delta sanity don hold one vessel wey belong to Ghana but get just one Ghana member and 12 Nigerians inside, and dem hold dem becus say dem thief our oil wey reach about 2 million litre. Na d director of information Navy, Rear Adm. Adedotun Ayo-Vaughan, nai tori dis one on monday for Abuja. D director tori say d ship off their automatic identification system so dat nobody go fit catch dem as dem be dey waka dey go Benin Republic. E come tori say dem go…
Governor Obaseki of Edo state don advise say d way forward nah to focus on d fundamentals
Governor of Edo state, Godwin Obaseki don advise say d way forward from wetin d country dey face right now na to focus on d fundamentals, and dat fundamentals go be to increase production instead of to dey increase interest rates as CBN just do am recently. Him tori dis one during d annual Edo zone bankers committee dinner wey dem hold for Benin city wey be d state capital. D governor come tori further say d next few months fit get as e be if small business nor fit…