D chairman of Nation drug and law enforcement agency NDLEA rtd General Mohammed Marwa, don advise parents to dey shine their eye for their children body because of d so many drug abuse mata for d country.
Him tori say make parents dey try to give better care to their children sake of say this fit help prevent d drug abuse wahala.
D oga tori dis mata for d ramadan lecture wey d Alhaji Mohammed Lawal memorial jummat mosque, Asokoro, Abuja organize. E tori say d prevention efforts wey dem put in place since three years now wey dem call war against drug abuse WADA don dey produce better results around d country and ask all citizens to join hands to fight against abuse.
E further tori say apart from d treatment and counselling centres wey dey 30 of d command around d country, dem don also set up call centers with free of charge help line wey go dey provide support for people wey need help with this abuse wahala.
E come ask for prayers for president Tinubu and every other government officials as ramadan dey start.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.