Navy don arrest one ghana vessel wey thief two million litre of our oil

Navy under operation Delta sanity don hold one vessel wey belong to Ghana but get just one Ghana member and 12 Nigerians inside, and dem hold dem becus say dem thief our oil wey reach about 2 million litre.

Na d director of information Navy, Rear Adm. Adedotun Ayo-Vaughan, nai tori dis one on monday for Abuja.

D director tori say d ship off their automatic identification system so dat nobody go fit catch dem as dem be dey waka dey go Benin Republic.

E come tori say dem go continue to dey work with other relevant body to make sure say dem deal with d people wey dey thief our oil.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment