D Peoples Democratic Party (PDP) don tori say dem legal team dey wait for Deputy Governor of Edo State, Philip Shuaibu for court over d mata of d party primary election wey happun for d state.
Na d deputy national publicity secretary of PDP, Ibrahim Abdullahi, nai tori dis one, and add say d party no dey shake for d deputy governor threat to carry d mata go court to declare am as d authentic PDP candidate ahead of d state governorship election wey dey come for September.
Abdullahi tori say PDP no dey fear d threat from d deputy governor of Edo State, Philip Shuaibu and im continual campaign for social media.
No forget say last week, Shuaibu enta d party national offices, dey demand recognition as d party legit governorship candidate.
D deputy governor still tori say dem dey threaten to remove im from office sake of im dey insist to do d right thing for Edo State PDP.
Remember say Shuaibu and Ighodalo come out as d PDP governorship candidates for Edo State afta simultaneous primaries wey happun on February 22, 2023.
But PDP come insist say na only Ighodalo be dia candidate and dem don give am certificate of return.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.