President Tinubu don sign executive orders wey go reform oil andd gas sector

Nigerian presido, Bola Tinubu, on Wednesday com sign three executive orders on top d oil and gas sector to bring fiscal incentives for related projects, reduce costs and time wey dem dey take do contract, and promote cost efficiency for local content requirements.

One statement from d special adviser to d presido on top media and publicity, Ajuri Ngelale, come tok say d policy directive wey presido give na to improve d investment environment and make Nigeria be d preferred place for investors wey dey eye d oil and gas sector for Africa.

According to d statement, dem tok say dem do plenty tok, analyze am and compare am wit oda places before dem take dis decision.

But Ngelale com tok say dem go publish d details of dis policy directives for one gazette and also dem go inform d public through d federal ministry of information and national orientation.

D presido spokesman explain say dem develop dis incentives together with d federal ministry of Justice, federal ministry of finance, federal ministry of petroleum, federal ministry of budget and economic planning, federal inland revenue service, d Nigerian national petroleum company limited, d Nigerian upstream petroleum regulatory commission, d Nigerian midstream and downstream petroleum regulatory commission, and d Nigerian content development and monitoring board.

E tok say dem don give d special adviser to d presido on top energy d order to coordinate all dis mata to make sure say dem carry d mata forward as quickly as possible.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment