Money wey dem print from 2015-2023 nor match with productivity- Edun

D minister of finance and coordinating minister of economy Wale Edun don tori senate committee on finance on wednesday say na d N22.7tn wey central bank of Nigeria tru d ways and means overdraft for government under Buhari from 2015-2023 nai land Nigeria for d heavy inflation wey d country dey face now. Oga minister com tok say dem just print money anyhow and spend am anyhow, and dem nor com make any effort to put d reckless spending side by side with productivity. but d senate com tok say…

What is Herbert Wigwe’s Tribute Teaching All Of Us

It appears Herbert Wigwe may have impacted more lives even in death, may his gentle soul and that of his wife Chizoba and his son Chizzy rest in peace. I wish that everyone, including me will live each day as if there is no tomorrow, and that we will make each day purposely count, both on how we treat ourselves and how we treat others. I am emotionally drained watching the night of tribute and listening to how Herbert had touched so many lives even though I never knew him…

Court don talk say Abure remain Labour party’s chairman

D court of appeal for Abuja don tori say Julius Abure remain chairman of Labour party. Justice Harma Barka wey deliver dis judgement come tok say mata wey dem bring against d chairman and others wey dem accused, na mata wey don pass before d election wey we dey call pre election matas and na also internal affairs mata wey nor suppose to even come court of appeal. D court come also tok say d people nor fit prove d allegation wey dem accused dem for.

Federal government don talk say dem go collect discos license back

Federal government com tori on wednesday say dem go withdraw all d licence wey dem give discos since dem nor dey gree supply light wey dey cause black out round we country. Minister of power chief Adebayo Adelabu nai tori dis mata for im X handle say despite effort from FG, some of dis power distribution company dey purposely nor dey wan give people light. Oga minister com still tori say as from now on, im go hold all of dem wey no wan dey supply light responsible including to…

Edo state house of assembly don tok say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu

Law makers for Edo state come tok on wednesday say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu sake of say e be like say e come go tori some kind mata wey concern d government for outside. But some people like d conference of registered political parties for Edo state com tok say dem no support d impeachment wey be like say dem start on March 5th and 21 members of d house don already sign am. Nor forget say nah last week nai Philip go d national secretariat of…