Law makers for Edo state come tok on wednesday say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu sake of say e be like say e come go tori some kind mata wey concern d government for outside.
But some people like d conference of registered political parties for Edo state com tok say dem no support d impeachment wey be like say dem start on March 5th and 21 members of d house don already sign am.
Nor forget say nah last week nai Philip go d national secretariat of pdp say make dem give him certificate of return becus say na him win d governorship primary election, and come tok say e go carry d mata go court, before pdp come still reply am say dem dey wait for am for court.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.