Federal government com tori on wednesday say dem go withdraw all d licence wey dem give discos since dem nor dey gree supply light wey dey cause black out round we country.
Minister of power chief Adebayo Adelabu nai tori dis mata for im X handle say despite effort from FG, some of dis power distribution company dey purposely nor dey wan give people light.
Oga minister com still tori say as from now on, im go hold all of dem wey no wan dey supply light responsible including to collect their licence. E further tok say im don also give others make dem repair transformers plus power lines wey damage.
Oga minister come finally beg Nigerians to patients say im dey work day and night to make sure say we d people start to get better light.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
Now true talk our ogbonge fed govt talk, this matter don tay wey dem suppose duam but we still thank God now say dem don wake up to do the right thing. My people make una just imagine even phcn wey dem certified make he dey give us light dey themselves kukuma day use generator, calamity for abrakadaba.