D minister of finance and coordinating minister of economy Wale Edun don tori senate committee on finance on wednesday say na d N22.7tn wey central bank of Nigeria tru d ways and means overdraft for government under Buhari from 2015-2023 nai land Nigeria for d heavy inflation wey d country dey face now.
Oga minister com tok say dem just print money anyhow and spend am anyhow, and dem nor com make any effort to put d reckless spending side by side with productivity.
but d senate com tok say dem go set up committee to investigate how dem take spend d ways and mean money, Minister Wale com further tori say dem go audit d N22.7tn wey dem print anyhow.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.