Federal government don tok say people wey benefit from d Nigerian education loan, go get two years after dem serve youth service finish to pay back.
Na d executive secretary of NELFund, Dr. Akintunde Sawyer, nai tori dis for d interview with News Agency of Nigeria for Abuja. E tory say d reason for d two year grace after youth service na to give all beneficiaries borku time to get work, and den repay d loan after dem stabilize.
Him com further tori say dem nor go still put pressure for those people wey nor fit get work within d space of two years since dem nor go see money take pay, but register go dey with employers to know who and who get loan to pay.
Nor forget say na June 12 for 2023 nai presido be sign d access to higher education act 2023 into law, so dat student go fit collect loan wey dem nor go pay interest to go pursue deir education for any school dem decide to go for we country.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.