Governor Alex Otti of Abia state com tori for one video wey omoelerinjare share for deir X handle say no more sharing money as dem dey do am before.
D governor tok say some people wey say na dem be stakeholders of Abia, dey fight back becus say im administration nor gree share money.
Governor Otti com tok say im nor go ever share money, so make those wey dem say dem be stakeholders find sometin else do, and im nor still worry since Abia people dey see wetin im dey use d money take dey do.
Oga Otti say d people of Abia dey see d good governance as e play out, and d people wey dey fight go loose, and Abia state under im administration go be destination for every good thing.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.