D minister of interior, Tunji Olubunmi-Ojo, don tori am for im X handle today to Nigerians wey dey d abroad say, d sweet experience wey im promise dem regarding d softness to get new or renew their international passport don com.
Minister Ojo say Nigerians abroad go com fit dey apply for their passport from inside their house.
And to do dis one, u go need to visit d website to apply as u dey see am for d picture.
We just wan troway salute to d minster for bringing sanitation to dis sector, we dey hope say other ministers go follow.
God go bless Nigeria.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.