D national civil society council of Nigeria (NCSCN), don beg presido make e take am as quick mata to appoint new minister wey go dey in charge of activities for d humanitarian ministry.
Remember say president Tinubu sack Beta Edu wey be d former minister for humanitarian affairs and poverty alleviation becus of d plenty wahala of mismanagement and money wey dem transfer to d wrong accounts, and since that time d ministry never get any minister.
D civil society council com tok say d mata wey happen d last time wey custom for sell 25kg bag of rice where some people for com kpeme for nor happen like dat if to say minister of humanitarian affairs dey to handle dat kind mata.
Dem com beg presido say make im treat d mata as urgent so dat d ministry go get minister.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.