NANS don ask for probe of d mismanagement of Ajaokuta steel

D National association of Nigerian student, NANS, don tok say make dem probe d way people take mismanaged money for Ajaokuta steel company and d national iron ore company wey dey kogi state. D association through deir president Lucky Emenofe com accused some official for d past government under Buhari, say dem mismanaged a whole $496 million as e concern d Ajaokuta steel. Lucky Emenofe come tori for im statement say, dem thank presido of d country for d way e dey try to make sure say d company work,…

Bishop Oyedepo don open care centers around d country to help people in need

Bishop David Oyedepo of living faith church wey we know as winners chapel don advise say make christians reach out to d people wey dey in need around dem to help with d hardship wey dey happen for we country right now. Bishop com tori further say, winners chapel don open plenty kingdom care centers to help d needy, and dis help go be through d winners satellite fellowship wey dey across Nigeria, as im com further tori say nor be weakness to ask for help when u need am.…

10 suspected dealers for illegal petroleum products don enter EFCC net

D Economic and financial crimes commission EFCC for Uyo Akwa Ibom state, don dey investigate 10 suspects wey dey deal on illegal petroleum product without d correct license. Na Mr. Dele Oyewale wey be d head of media and publicity for d commission, nai tok dis mata for one statement yesterday. According to Mr. Dele, na d Nigerian navy forward operating base nai catch dem with their ship and come handover dem give EFCC. D Navy handing over officer, Captain Uche Aneke, com tok say dem go continue to dey…

Belief system

Wetin be your belief system? if you fit change your belief system, most of d tins wey you dey struggle with go change. So, as you dey start your day, ask yourself say wetin be dat tin about your belief system wey you need to change right now, and den you go come take beta concrete steps to see say e change, and then watch as tins go come start to improve. Have a blessed day.