D Economic and financial crimes commission EFCC for Uyo Akwa Ibom state, don dey investigate 10 suspects wey dey deal on illegal petroleum product without d correct license.
Na Mr. Dele Oyewale wey be d head of media and publicity for d commission, nai tok dis mata for one statement yesterday. According to Mr. Dele, na d Nigerian navy forward operating base nai catch dem with their ship and come handover dem give EFCC.
D Navy handing over officer, Captain Uche Aneke, com tok say dem go continue to dey do deir job to make sure say everywhere for Akwa Ibom free of people wey dey thief d national cake.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.