NANS don ask for probe of d mismanagement of Ajaokuta steel

D National association of Nigerian student, NANS, don tok say make dem probe d way people take mismanaged money for Ajaokuta steel company and d national iron ore company wey dey kogi state.

D association through deir president Lucky Emenofe com accused some official for d past government under Buhari, say dem mismanaged a whole $496 million as e concern d Ajaokuta steel.

Lucky Emenofe come tori for im statement say, dem thank presido of d country for d way e dey try to make sure say d company work, but dat nor com mean say dem nor go make dose wey mismanage d money pay for wetin dem do, becus making dem pay for d embezzlement and mismanagement crime wey dem commit, go help to make sure say others nor go attempt to thief when d company start to work again.

D president of d association com call on anti graft bodies to make sure say dem shine deir eye put for d company body.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment