Di presido for Rotary international, Gordon R Mclnally, don advise say make Nigeria make sure say dem shine eye on top polio mata, to make sure say e nor come back again for di country.
D presido of rotary international come tori dis one with journalist for Abuja after him carry some members of d organization to visit presido Tinubu.
Gordon wey be rotary president com tori say one of di reason wey make dem com see presido Tinubu na to tell am say thank you for how Nigeria don take pursue polio comot from d country since 2019.
Gordon come further tory say, even if Nigeria dey certified free from polio since 2019, make Nigeria still shine eye for di polio mata to make sure e nor return, say dem wan see say e nor return to we country or any other country for Africa and any part of di world.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.