Di Osun state governor, Ademola Adeleke, don finally pack enter di Okefia government house, Osogbo, wey go now be di official residence for di governor.
Dis dey happen almost one year and four months after Ademola Adeleke become governor of di state.
Although members of opposition party don complain say di governor suppose to create wetin go solve people problem from di wahala wey dem dey face on top di subsidy removal mata, instead of wetin nor go impact any life for di state.
But di governor further tori say, im administration go continue to fix and upgrade assets for Osun state because even pikins dem wey dem never born go come meet dem.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.