Emergency numbers to call for Edo state na 112 or 739

Di Edo state commissioner for communication and orientation, Chris Nehikhare, don encourage we di people for di state to go about their lawful businesses and activities without fear, and ask them to call di state emergency numbers wey be 112 or 739 to report all suspicious persons or activities within their environment.

Dis assurance dey com in d midst of d mata wey happen regarding di state PDP chairman Tony Aziegbemi, tori say d people wey whisk am comot from im car on friday night and carry am go unknown location never still contact any member of im family.

But according to Chris Nehikhare, government and security agencies dey on top di mata, and dem go continue to protect di lives and property of people for di state.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment