Governor of Anambra state, Charles Chukwuma Soludo, don tori we di people say, im never receive any salary since wen im become governor for di state.
Soludo tori dis mata during d two years anniversary of e administration, wey dem hold for Akwa, di state capital, on sunday.
Di governor com further tori say, di first lady still dey drive e own personal vehicles because say she nor get official car, and all dis na because say im dey reduce cost of governance, and since wen e become governor e administration never borrow any money.
According to di governor dem choose not to borrow, but to show how to do plenty things with small money.
We wish Anambra state well.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.