NANS say make dem give student 5years after NYSC to take repay student loan

Di National Association of Nigerian Students, don tok say e nor go dey possible for student wey take loan to pay back within two years after National Youth Service Corps. Dem tok say people wey dey get work after NYSC nor dey reach ten percent, so derefore dem dey ask make di student loan repayment start 5 years after NYSC. Na di association president, Lucky Emonele, nai tori dis one on Monday during di public hearing wey di senate committee on education and TETFUND and di house of representatives committee…

Parents say dem demand justice over their pikin wey kpai as she dey prepare to go london go study

Di parents of Rebekah Sekidika, di first class graduate wey kpai from just one simple check up and wetin oyibo dey call procedure, because she been dey complain say she nor see her period for sometime, don com out com demand for justice over her death. Di parents say dem accuse di hospital of medical negligence, because their daughter dey very healthy and even attend her online class while she dey wait to see doctor. According to Rebekah father wey tori say, e never even reach how many minutes wey…

NAAT don say dem go start warning strike on Wednesday

Di National Association of Academic Technologist (NAAT), don tori say dem go start three day warning strike on Wednesday March 20th, because of say, dem no pay them their four months salary wey dem owe dem. Dem say dis four months salary nah d withheld salary wey presido approved since to pay, say other unions don get their pay and na only dem remain. According to di association president Ibeji Nwokoma, im tori say this warning strike na to send message about di four months salary wey presido approved wey…

FG say dem plan to complete di $1bn world bank loan for IDPs and Agriculture

Federal government say dem dey talk with world bank on how to complete di process to get $1bn loan, and dem go use dis loan take address di internally displaced persons wey be IDPs, and also to use am boost agriculture around di IDPs. Di tori wey dey inside world bank document wey dem title solutions for di internally displaced and host communities projects and rural access and agricultural marketing project. Dem say di IDP loan go be $500 million and di agricultural project loan go com be $550 million.…

Concentrate on what you want

I don find out say, if you concentrate on wetin you want and dey think less about wetin never work, wetin you concentrate, focus and channel your energy put, go just dey find way to happen and work eventually. So today as you start your day, try to concentrate and focus more on wetin you want. Have a beautiful day.