FG say dem plan to complete di $1bn world bank loan for IDPs and Agriculture

Federal government say dem dey talk with world bank on how to complete di process to get $1bn loan, and dem go use dis loan take address di internally displaced persons wey be IDPs, and also to use am boost agriculture around di IDPs.

Di tori wey dey inside world bank document wey dem title solutions for di internally displaced and host communities projects and rural access and agricultural marketing project.

Dem say di IDP loan go be $500 million and di agricultural project loan go com be $550 million.

According to di tori wey dey their website, dem say dis IDP plan and agricultural plan go help to better di lives of people wey dey displaced.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment