Di parents of Rebekah Sekidika, di first class graduate wey kpai from just one simple check up and wetin oyibo dey call procedure, because she been dey complain say she nor see her period for sometime, don com out com demand for justice over her death.
Di parents say dem accuse di hospital of medical negligence, because their daughter dey very healthy and even attend her online class while she dey wait to see doctor.
According to Rebekah father wey tori say, e never even reach how many minutes wey Rebekah wey be plan to go study abroad enter di theatre room before im start to hear say e be like say something don happen, only for im to enter d theatre room and see im daughter Rebekah inside pool of blood, and one of d medical person come dey tell im say sorry dem tried their best.
Di family say dem accuse di hospital for medical negligence and want justice for Rebekah.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.