Di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don find 14 of their officers guilty of corruption and misconduct wey happen when dem dey perform their duties, and dis misconduct and corruption dey happen since four months ago.
Na Olalekan Bakare-Oki wey be LASTMA general manager, nai tori dis mata for im interview with di News Agency of Nigeria (NAN) on Tuesday for Lagos.
Bakare-Oki tok say, since im resume office on November 20, 2023, 18 officers don face authority personnel management board over misconducts, and dem com find 14 guilty, and dis officers wey dem find guilty don receive punishment wey even amount to rank reduction and dismissal, involuntary retirement and warning letters.
Di general manager come tok say dem get stipulated rules and their code of conduct.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.