Justice James Kolawole Omotosho of di federal high court for Abuja, don dismiss di lawsuit wey one member of Seventh Day Adventist Church of Nigeria, Ugochukwu Uchenwa file to stop elections and exams to dey hold on Saturdays for we country.
Di member been carry dis mata go for court because say nah Saturdays nai dem take dey hold service.
But di court com described di case wey Ugochukwu file against di government as “frivolous, vexatious, bothersome, and unjustified.”
Di judge come further tori say di Seventh day Adventist church na minority, and dem nor go fit just impose their doctrine of Saturday worship on other majority of Christians for di country.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.