FG say dem plan to complete di $1bn world bank loan for IDPs and Agriculture

Federal government say dem dey talk with world bank on how to complete di process to get $1bn loan, and dem go use dis loan take address di internally displaced persons wey be IDPs, and also to use am boost agriculture around di IDPs. Di tori wey dey inside world bank document wey dem title solutions for di internally displaced and host communities projects and rural access and agricultural marketing project. Dem say di IDP loan go be $500 million and di agricultural project loan go com be $550 million.…

Concentrate on what you want

I don find out say, if you concentrate on wetin you want and dey think less about wetin never work, wetin you concentrate, focus and channel your energy put, go just dey find way to happen and work eventually. So today as you start your day, try to concentrate and focus more on wetin you want. Have a beautiful day.

Custom don reopen Kebbi border

Di Nigeria customs service, Kebbi Command, don reopen d Kamba border for trade, but only for international trade dis time. And dis directive dey com from Bashir Adewale wey be di comptroller general according to tori. Dem further tori say no grains go ship out because of di scarcity of food for Nigeria.

Soludo say him never receive salary since two years

Governor of Anambra state, Charles Chukwuma Soludo, don tori we di people say, im never receive any salary since wen im become governor for di state. Soludo tori dis mata during d two years anniversary of e administration, wey dem hold for Akwa, di state capital, on sunday. Di governor com further tori say, di first lady still dey drive e own personal vehicles because say she nor get official car, and all dis na because say im dey reduce cost of governance, and since wen e become governor e…

Adeleke don move go new govt house

Di Osun state governor, Ademola Adeleke, don finally pack enter di Okefia government house, Osogbo, wey go now be di official residence for di governor. Dis dey happen almost one year and four months after Ademola Adeleke become governor of di state. Although members of opposition party don complain say di governor suppose to create wetin go solve people problem from di wahala wey dem dey face on top di subsidy removal mata, instead of wetin nor go impact any life for di state. But di governor further tori say,…

Emergency numbers to call for Edo state na 112 or 739

Di Edo state commissioner for communication and orientation, Chris Nehikhare, don encourage we di people for di state to go about their lawful businesses and activities without fear, and ask them to call di state emergency numbers wey be 112 or 739 to report all suspicious persons or activities within their environment. Dis assurance dey com in d midst of d mata wey happen regarding di state PDP chairman Tony Aziegbemi, tori say d people wey whisk am comot from im car on friday night and carry am go unknown…

Nigerian passport don rank 98th for di world

According to one tori from Henley index report, Nigerian passport don rank 98th for di world, with free access to only 45 destinations for di world. And dis na di 45 destinations Nigerians fit travel to with their passport.  1.Barbados2. Benin3. Burkina Faso4. Burundi5. Cambodia6. Cameroon7. Cape Verde Islands8. Chad9. Comoro Islands10. Cook Islands11. Cote d’Ivoire12. Djibouti13. Dominican Republic14. Fiji15. Ghana16. Guinea17. Guinea-Bissau18. Haiti19. Iran20. Kenya21. Kiribati22. Lebanon23. Liberia24. Madagascar25. Maldives26. Mali27. Mauritiana28. Mauritius29. Micronesia30. Montserrat31. Mozambique32. Niger33. Niue34. Palau Islands35. Rwanda36. Samoa37. Senegal38. Sierra Leone39. Somalia40. St. Kitts and…

Think Twice

Sometimes, if we go just use small time take think twice about any situation wey happen, we go discover say we for nor take di action wey we take regarding dat situation. I don discover say, di small time wey we dey use take think twice before we take any action, go save us from so many trouble and regret. So, as you dey start your day, incase any mata or situation happen, just remember say you read for somewhere say, no mata wetin happen, make you use small time…