Who Be Patriotic Citizen?

According to oxford dictionary, patriotism means dedication, devotion and better support for your country. Den com tok say patriotic citizen nah di feeling of devotion and attachment wey people or persons get for their country. My question now be say, you be patriotic citizen? and wetin patriotic citizen mean to you and how patriotic citizen take dey behave? If we quote Allen Onyema, d chairman of Air Peace, where him for tok about patriotism during one interview with vanguard, him come tori say, “As citizen of Nigeria, all of us…

Rotary don advise Nigeria to shine eye well on top polio mata

Di presido for Rotary international, Gordon R Mclnally, don advise say make Nigeria make sure say dem shine eye on top polio mata, to make sure say e nor come back again for di country. D presido of rotary international come tori dis one with journalist for Abuja after him carry some members of d organization to visit presido Tinubu. Gordon wey be rotary president com tori say one of di reason wey make dem com see presido Tinubu na to tell am say thank you for how Nigeria don…

This japa mata

One man don talk say e nor understand d sense of how person go struggle gather say something like N20 million take japa to another man’s land, only for d person to go start to hussle from scratch, d man say him wan know which kind brain dese people get o. Na instablog9ja nai share dis tori for e X handle. Abeg help di man understand how people dey manage struggle for millions to take japa and reach dere go start from scratch. God bless Nigeria

NANS don ask for probe of d mismanagement of Ajaokuta steel

D National association of Nigerian student, NANS, don tok say make dem probe d way people take mismanaged money for Ajaokuta steel company and d national iron ore company wey dey kogi state. D association through deir president Lucky Emenofe com accused some official for d past government under Buhari, say dem mismanaged a whole $496 million as e concern d Ajaokuta steel. Lucky Emenofe come tori for im statement say, dem thank presido of d country for d way e dey try to make sure say d company work,…

Bishop Oyedepo don open care centers around d country to help people in need

Bishop David Oyedepo of living faith church wey we know as winners chapel don advise say make christians reach out to d people wey dey in need around dem to help with d hardship wey dey happen for we country right now. Bishop com tori further say, winners chapel don open plenty kingdom care centers to help d needy, and dis help go be through d winners satellite fellowship wey dey across Nigeria, as im com further tori say nor be weakness to ask for help when u need am.…

10 suspected dealers for illegal petroleum products don enter EFCC net

D Economic and financial crimes commission EFCC for Uyo Akwa Ibom state, don dey investigate 10 suspects wey dey deal on illegal petroleum product without d correct license. Na Mr. Dele Oyewale wey be d head of media and publicity for d commission, nai tok dis mata for one statement yesterday. According to Mr. Dele, na d Nigerian navy forward operating base nai catch dem with their ship and come handover dem give EFCC. D Navy handing over officer, Captain Uche Aneke, com tok say dem go continue to dey…

Belief system

Wetin be your belief system? if you fit change your belief system, most of d tins wey you dey struggle with go change. So, as you dey start your day, ask yourself say wetin be dat tin about your belief system wey you need to change right now, and den you go come take beta concrete steps to see say e change, and then watch as tins go come start to improve. Have a blessed day.

Herbert Wigwe, wife and son don go home finally

Dem don finally bury Herbert Wigwe, e wife and e pikin for im hometown omueke, Isiokpo for Rivers state. Plenty people from all works of life follow attend d funeral church service wey happen for Redeemed Christian church of God parish for Isiokpo, before dem come go bury dem privately. We pray to God to grant dem eternal rest and make Him give d family d grace to bear dis loss wey we nor just understand.