Lion nor dey think like sheep or care about elephant, im just know say na im be d king of both d jungle and d forest. As you dey start your day, make u make up your mind to think like d lion, so dat u go handle any mata wey go arise like d lion. Make yu enjoy your day.
Month: March 2024
Civil society council don beg presido to appointment new humanitarian minister
D national civil society council of Nigeria (NCSCN), don beg presido make e take am as quick mata to appoint new minister wey go dey in charge of activities for d humanitarian ministry. Remember say president Tinubu sack Beta Edu wey be d former minister for humanitarian affairs and poverty alleviation becus of d plenty wahala of mismanagement and money wey dem transfer to d wrong accounts, and since that time d ministry never get any minister. D civil society council com tok say d mata wey happen d last…
NIN matter,Nigerians for abroad don appeal to CBN to remember them
Nigerians for abroad don lament say CBN wey be central bank of Nigeria nor carry dem along on top d NIN linkage matter. Na Clement Osuya wey be d presido of d world united consumer organization nai tori dis mata for one interview, im talk say CBN nor even give any direction on d way forward for Nigerians wey dey d abroad on how dem go take waka for d linkage of d NIN wey CBN say d deadline nah March 1st 2024 wey don already pass. Osuya com beg…
FG don talk say health workers must resign their appointment before dem japa
D minister of state for health, Dr. Tunji Alausa, don tok on Saturday say federal government don give direction say any health worker wey dey plan to pack go d abroad wey we don know as japa dese days must resign deir appointments before dem japa. Dr Alausa com tori dis one when im visit d Neuro-Psychiatric hospital, Aro, for Abeokuta, Ogun State. D minister tori say no more leave of absence as dem dey do am before, and dis order dey among d executive order wey presido sign as…
Police don rescue 16 pregnant girls and eight babies inside one baby factory for Abia state
Abia state police command don catch baby factory for Aba, and dem don rescue 16 pregnant women plus eight pikins, wey be five boys and three girls, during d operation wey dem carry out on Thursday evening. One police officer from d rapid response squad wey dem for parade d women on Friday, com tok say dem rescue d women based on d information wey d people wey dey around give dem. D rapid response squad officer tok say, d building wey all dis for happen so, na for one…
Minister of interior don tell Nigerians for abroad say the sweet experience im promise don land
D minister of interior, Tunji Olubunmi-Ojo, don tori am for im X handle today to Nigerians wey dey d abroad say, d sweet experience wey im promise dem regarding d softness to get new or renew their international passport don com. Minister Ojo say Nigerians abroad go com fit dey apply for their passport from inside their house. And to do dis one, u go need to visit d website to apply as u dey see am for d picture. We just wan troway salute to d minster for bringing…
Tony Elemule don advised federal government to privatize transmission lines
D chairman of transnational corporation (Transcorp) and united bank of Africa (UBA) don advise government to change d power sector, and make dem also privatize transmission lines wey go help d economy grow, as e be say d economy just dey struggle. Na for d interview wey im sidon with Bloomberg na him for tok say d wahala wey dey d electricity market nor make any industry grow becus of poor production. Oga Tony com tori more say nor be good tin say Nigerians still dey depend on generator dis…
No more sharing money for stake wey get holders
Governor Alex Otti of Abia state com tori for one video wey omoelerinjare share for deir X handle say no more sharing money as dem dey do am before. D governor tok say some people wey say na dem be stakeholders of Abia, dey fight back becus say im administration nor gree share money. Governor Otti com tok say im nor go ever share money, so make those wey dem say dem be stakeholders find sometin else do, and im nor still worry since Abia people dey see wetin im…
Federal govt don tok say repayment of student loan na 2 years after youth service
Federal government don tok say people wey benefit from d Nigerian education loan, go get two years after dem serve youth service finish to pay back. Na d executive secretary of NELFund, Dr. Akintunde Sawyer, nai tori dis for d interview with News Agency of Nigeria for Abuja. E tory say d reason for d two year grace after youth service na to give all beneficiaries borku time to get work, and den repay d loan after dem stabilize. Him com further tori say dem nor go still put pressure…
Man don beat e wife die for Rivers state
Tori tok am say one man wey get three pikin wey dem dey call Michael Chiozie for Rivers state don beat e wife and kpai am on top house rent mata. . Dem say d suspect kpai e wife wey her name be Ufuoma Chidozie on Tuesday for Mile 4 area for Port Harcourt. D police public relations officer of d state command, Grace Iringe-Koko com tok yesterday say dem don arrest d suspect wey be Michael Chidozie and don hold am on top d mata say e beat e…