Federal government on thursday for Abuja com launch one new satellite pay television wey dem tok say go give Nigerians better service for their money. Na George Akume wey be d secretary to d government of d federation wey e senior special assistant Prof. Babatunde Bernand represent, nai com open dis Nigerian satellite television wey happen for d shehu Yar’Adua center for Abuja. Congratulations Nigerians.
Month: March 2024
D future of our youth dey Nigeria
D president of Africa development bank (AFDB) Dr. Akinwunmi Adesina don tok say d future of our youth nor dey d land of any other country but instead na Nigeria here nai dat future dey. Dr. Akinwunmi tok dis one during d 2023 Awolowo leadership prize ceremony where dem for give im d award. Dr Akinwunmi com advised say instead of make d youth dey choose to japa, wey nor dey bring about better development, make we d youth take pride in wetin we get as per d youth power…
Money wey dem print from 2015-2023 nor match with productivity- Edun
D minister of finance and coordinating minister of economy Wale Edun don tori senate committee on finance on wednesday say na d N22.7tn wey central bank of Nigeria tru d ways and means overdraft for government under Buhari from 2015-2023 nai land Nigeria for d heavy inflation wey d country dey face now. Oga minister com tok say dem just print money anyhow and spend am anyhow, and dem nor com make any effort to put d reckless spending side by side with productivity. but d senate com tok say…
What is Herbert Wigwe’s Tribute Teaching All Of Us
It appears Herbert Wigwe may have impacted more lives even in death, may his gentle soul and that of his wife Chizoba and his son Chizzy rest in peace. I wish that everyone, including me will live each day as if there is no tomorrow, and that we will make each day purposely count, both on how we treat ourselves and how we treat others. I am emotionally drained watching the night of tribute and listening to how Herbert had touched so many lives even though I never knew him…
Court don talk say Abure remain Labour party’s chairman
D court of appeal for Abuja don tori say Julius Abure remain chairman of Labour party. Justice Harma Barka wey deliver dis judgement come tok say mata wey dem bring against d chairman and others wey dem accused, na mata wey don pass before d election wey we dey call pre election matas and na also internal affairs mata wey nor suppose to even come court of appeal. D court come also tok say d people nor fit prove d allegation wey dem accused dem for.
Federal government don talk say dem go collect discos license back
Federal government com tori on wednesday say dem go withdraw all d licence wey dem give discos since dem nor dey gree supply light wey dey cause black out round we country. Minister of power chief Adebayo Adelabu nai tori dis mata for im X handle say despite effort from FG, some of dis power distribution company dey purposely nor dey wan give people light. Oga minister com still tori say as from now on, im go hold all of dem wey no wan dey supply light responsible including to…
Edo state house of assembly don tok say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu
Law makers for Edo state come tok on wednesday say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu sake of say e be like say e come go tori some kind mata wey concern d government for outside. But some people like d conference of registered political parties for Edo state com tok say dem no support d impeachment wey be like say dem start on March 5th and 21 members of d house don already sign am. Nor forget say nah last week nai Philip go d national secretariat of…
President Tinubu don sign executive orders wey go reform oil andd gas sector
Nigerian presido, Bola Tinubu, on Wednesday com sign three executive orders on top d oil and gas sector to bring fiscal incentives for related projects, reduce costs and time wey dem dey take do contract, and promote cost efficiency for local content requirements. One statement from d special adviser to d presido on top media and publicity, Ajuri Ngelale, come tok say d policy directive wey presido give na to improve d investment environment and make Nigeria be d preferred place for investors wey dey eye d oil and gas…
People don dey para and protest for d poor state of Auchi Road
Protesters wey dey under Concerned Citizens of Edo State on Tuesday block Jattu axis for Benin-Auchi Highway sake of say d road dey very bad. D protesters wey come from different communities for Auchi com disturb business and movement of vehicles becus of d way d road take bad. One protester wey im name na John, tori give journalists say dem dey protest to show say dem no dey happy with how d federal roads for d state be, especially d Okene-Auchi-Ekpoma-Benin expressway. E tok say dem dey vex becus…
President say dem don attract $30bn direct investment
President Bola Tinubu talk say im administration wey never reach one year don attract $30 billion direct foreign investment commitments to help boost d Nigerian economy. Tinubu tori dis one for d 2023 Leadership annual conference and award for Abuja. D event, wey get d theme “An Economy in Distress: The Way Forward”, wey d Leadership Group of Leadership Newspapers organized. Tinubu, wey d minister of Information and national orientation, Alhaji Mohammed Idris represent for d event , tok say Nigerian economy no dey inside wahala, but e dey face…